Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Okafor Phebe Chukwunonye

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Okafor Phebe Chukwunonye

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Okafor Phebe Chukwunonye

 

No be say I be the perfect student;

But na my teacher be the perfect teacher;

When God create you,dear teacher;

E be like say He get me for mind;

He created you and gave me a friend;

When I dey confused,You go waka in with you smile;

You go calm me down and say “E go clear”.

 

When God created you ,dear teacher;

Him give me a counsellor;

Those times wey i no know road wey i go pass ;

I follow you wey know road.

The love wey you dey give;

The bright smile wey always dey your face;

You light the potentials and creativity wey I know no say they dey inside of me;

You get that special gift to dey teach;

You add love to whatever you dey do.

 

When everyone don look down on me;

They think say I no fit be anything;

You tell me say one day ,I go be a great teacher too;

Today na teacher I be;

No be only because I wan be like a mini you;

But because me sef wan touch lives just like you touched mine;

Na you make me who I be today;

Because say you believed in me.

 

 

 

This poem by Okafor Phebe Chukwunonye emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Okafor Phebe Chukwunonye

My name is Okafor Phebe, a Science teacher and also a student of the University of Benin. I am very passionate about impacting lives and learning.

Subscribe
Notify of
guest

2 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments