Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Otohinoyi Audu Lydia

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Otohinoyi Audu Lydia

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Otohinoyi Audu Lydia

 

Everything  get seasons, but my teacher no get.

All the seasons for my teacher life na how e go tay help me.

 

My teacher wey be my model.

Na my teacher sow this seed.

Na  the kindness wey him show me make me say make like book.

Wetin I for become if I no get  teacher wey care for me like this?

 

I know say I get big potentials inside me, but I no no how I go take manifest am.

Na my teacher con light the candle say make I see road well.

 

My desire tay tay to be like my teacher don come true today.

When I no dey see anything at all, na my teacher  dey show me light.

I don become that light today wey be say others dey see from.

 

Na teacher I be today because my teacnher no give up for my matter.

Na my teacher  be my strength,

Na my teacher be my model.

My teacher, my best.

 

 

 

This poem by Otohinoyi Audu Lydia emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Otohinoyi Audu Lydia

My name is Otohinoyi Audu Lydia. I’m a Computer Scientist and a Fashion Designer. I obtained a Higher National Diploma Certificate on Computer Science, from Auchi Polytechnic.

Subscribe
Notify of
guest

2 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments