Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Okeleke Gift Victoria

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Okeleke Gift Victoria

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Okeleke Gift Victoria

 

I don tel my mama sa I wan be doctor

I don tel my papa say I go build hospital for am

I don tel my neighbors dem finish

sa dia health mata go be my concern wen I grow

 

as pikin wey I be

I carry my dreams go skul

Come mit anoda Papa nd mama

Wey Carry di mata for head

To make my future bright and colourful

 

I no hw to writ today na because of my teacher

Im see me dey writ leters lik drawings

Im luk me smile den com hold my smal hand

As im dey cal di name of di alphabet

Im dey also follow me writ me

 

If I tok about hw I take no hw to speak beta Englis

I no go forget hw im make me pratis am always

even wen I reach house after sch

If say you no flog me wen I no do my homwork

I for dey lazy to dey read mi bok

Na all dis rol wey you play for my life

make am possible for me to achieve mi dreams

 

I don bi that doctor wey I tok say I wan bi

Bi say u giv ur time and resources

to fin all the knowledge wey I need

Com still mak sure sa I learn am wel wel

To de fit for my choice of career.

 

 

This poem by Okeleke Gift Victoria emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Okeleke Gift Victoria

My name is Okeleke Gift Victoria. I’m currently an I.T student of Federal Polytechnic Nekede Owerri, Imo state, studying Pharmaceutical Technology.

Subscribe
Notify of
guest

3 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments