Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By David Tamunoemi Okoye

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By David Tamunoemi Okoye

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By David Tamunoemi Okoye

 

First, I Wan thank God for my teacher’s life

The person wey dey always give me drive

Drive to be better

Na, you make sure I no remain in gutter

Drive to be wiser

Na you be my number one advisor

Drive to be Braver

Na, you make me an explorer

 

This Story don tey, I no go lie

The Story of how you don change my life

Told me to keep pushing till I reach the sky

My teacher, My teacher your rating don pass five.

This toast dey for you

And for me too

for all we don been through

 

Some people no do dey gree

That na my teacher be my O.G

Leave them joor, them no sabi

Wetin this my teacher don do for me?

 

Wetin, I go know if not for my teacher?

Person wey dey dispense knowledge like a preacher

Wetin, I go do if not for my teacher?

My guy wey always dey beside me, you be my number one believer

Who I go be if not for my teacher?

Na, you turn me into a leader

 

With all these tori I Don tori

The jist I wan yarn be say

Na my teacher make me who I be today

 

 

 

This poem by David Tamunoemi Okoye emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

David Tamunoemi Okoye

My name is David Tamuneomi Okoye. I am currently a student furthering my education in engineering. Writing and poetry is a very important hobby of mine.

Subscribe
Notify of
guest

3 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments