Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Michael Onoruoiza

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Michael Onoruoiza

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Michael Onoruoiza

 

My teacher, my source.

My teacher, my big inspiration wey make me dream big.

 

My teacher, my motivator.

When I think say nothing fit come out from brain wey too dull, he prove am say na lie.

 

Anytime wey hope go down, na so he go bring faith.

Follow the passage of the Bible wey talk say “any good thing fit come  from Nazareth?”, na yes go be my motivator answer.

 

Limits plenty for way because of brain wey dull, na so he break those limits comot.

Teacher wey believe me pass the way wey I believe myself.

 

Wetin bring this motivation?

This one no be hope wey no get root?

 

How tree go take grow wey root no strong?

He say e dey possible.

 

I hear am say na my mind be problem.

I hear am say they no born me say make I look like failure.

 

I no fit sit down hear these words again,

these words don enter my mind well well.

 

Student change mindset because the teacher talk say e dey possible.

Na happiness con show after the long night.

 

Morning con bright pass wetin I fit believe.

Give up no con be option.

 

Behind this boy wey be Software Engineer, na my teacher.

Behind this smile, na my teacher.

 

My teacher, my source!

 

 

 

This poem by Michael Onoruoiza emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Michael Onoruoiza

I’m by name Michael Onoruoiza. I’m a Software Engineer in making. Presently running my Bsc in Bayero University, Kano. Left with a year to round off with my academic activities.

Subscribe
Notify of
guest

5 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments