How Love And Respect Take Important For Friendship Wey Get Head! By Eme Efa Etim
Wetin any kind of friendship need, na love and respect
Na it be de glue wey de hold dem together
Anybody need am to hold or forge him relationship
With the person him wan call friend.
Love dey give comfort; respect dey give courage.
Love dey humble person and respect dey inspire
Love na de care you feel from d person side,
E de show for d person face as nothing de to hide.
Love and respect dey important for friendship wey get head,
Because that friendship go de pure and e go full with bliss
Sealed with commitment, you go see am for their eyes
Na the many ways wey de make them wise.
Love and respect dey hard you see,
But in the end, na it be key;
For dat great friendship,
wey we all want and need.
Eme Efa Etim
My name is Eme Efa Etim and I am a graduate of Arthur Jarvis University, Akpabuyo, Cross River State.