How Love And Respect Take Important For Friendship Wey Get Head! By Orere Israel Oghenefejiro

Recently updated on February 15th, 2022 at 04:47 am

How Love And Respect Take Important For Friendship Wey Get Head! By Orere Israel Oghenefejiro

How Love And Respect Take Important For Friendship Wey Get Head! By Orere Israel Oghenefejiro

HAND IN HAND

Them no born us together.

We no be brother, we no be sister but people go always ask me  if na the same mama born us.

Well, na only better friendship go make person ask that kind question.

 

My friend, my friend. My very good friend.

He no dey take eye see when I dey cry.

When things no dey go well, we dey there for each other.

 

My friend. Come rain, Come shine, the bond no fit break.

This one don pass love. Abi wetin you go call am?

We dey do everything together.

Nothing good go dey  wey him no go tell me about. Na better brother him be.

 

When he talk, I dey listen. When I talk himself dey listen.

We dey sincere with ourselves and we know ourselves very well.

Wetin he like, I Sabi and wetin he no like, I  Sabi.

Nothing go make me go do wetin he no like because I value our friendship.

We dey respect ourselves Well well.

 

Na so he suppose be.

As we dey together, na the way we dey treat ourself make us tight kakaraka.

He be my person and I no go do wetin go make am vex.

I no fit replace am.

Who person love, who person call him friend, him no go offend. Na true friendship be that.

 

My friend, you too much. Three gbosa for you!

 

 

Orere Israel Oghenefejiro

My name is Israel Oghenefejiro Orere. I am a Chemical Engineering student at the University of Lagos. I am passionate about learning new things every day.

Subscribe
Notify of
guest

4 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments