Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Ugochukwu Kosisochukwu Judith

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Ugochukwu Kosisochukwu Judith

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Ugochukwu Kosisochukwu Judith

 

No be say my mama no try for me

Na she carry me for belle for nine months

Come watch my infant head

No be say my papa no try for me

Na him dey cater for my needs

Na him dey bring money for school fees

Both mama and papa put me for school

Where I take sabi my teacher

 

She carry my matter for her head from first day as she go do for her pikin

Dey check if I dey  improve for both skills and mind

As pikin wey dey my age suppose dey do for school

Na she make me sabi say I fit achieve anything

Anything at all wey I put my mind for in this life

She no dey waste time to correct me for times wey I mess up

She go tell me why she dey flog me

She go also show me the correct way I go take do am

Na so I become better pikin

 

Na my teacher show me plenty values

Values wey go make me better citizen

She make me know say to dodge work no go do me well

Say na hardwork I need to reach any height wey I want

Say na consistency and integrity go keep me for that height

Say na tolerance go help me live well with people

Say ingratitude na badbelle

Na why I talk say my teacher make me who I be today

 

 

This poem by Ugochukwu Kosisochukwu Judith emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Ugochukwu Kosisochukwu Judith

I am Ugochukwu Kosisochukwu, a Nigerian undergraduate and a personal development enthusiast.

Subscribe
Notify of
guest

4 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments