Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Orere Israel

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Orere Israel

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Orere Israel

 

A, B, C, D, na so I take start

From person wey no sabi spell him name

From person wey no sabi add two and two

Na him don big now

 

I no go ever forget the times when I dey struggle

You stand by me,

You go explain until I understand

My teacher, your patience and love dey special

 

You no only teach me book, you teach me better behaviour

You go punish me when I do bad

From there I start to dey learn wetin good and wetin bad

To avoid punishment, I start to dey behave myself

 

Those times, I no know say you dey train me

You dey build me so tomorrow I go fit stand kakaraka

Today, my life don better because you teach me better behaviour

 

Anytime I achieve anything today

My mind dey carry  me back to the work wey all my teachers do for my life

They teach me say if I no dey determined, I no fit achieve anything

 

My teacher tell me say failure no be the end

Them talk say if I fail, make I dust body try again

Today I no dey fear learn anything

I no dey fear do anything

 

I know say failure and success dey hand in hand

Last last, I go reach my goal

To all my teachers wey don touch my life

God go bless you

 

 

 

This poem by Orere Israel emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Orere Israel

My name is Israel Oghenefejiro Orere. I am a Chemical Engineering student at the University of Lagos. I am passionate about learning new things every day.

Subscribe
Notify of
guest

2 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments