Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Chidera Amarachi Udochukwu

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Chidera Amarachi Udochukwu

Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Chidera Amarachi Udochukwu

 

1) Teachers be like potters wey dey use chalk and clay,

Bake young minds under night and day,

After parents na teachers be the next gods we dey see,

They no dey only teach us how to count A to Zees,

Dem dey tell us say we fit be the best if we wan be,

 

2) Teaching na calling and teachers na angels,

Wey dey shape us both fundamentally and mentally,

Them be unsung heroes wey dey use love water our talents,

Nurture us with patience to meet up with challenges,

And Become useful citizens wey dey balanced and gallant,

 

3) Education na passport for the future,

And teachers na pilots wey dey prepare people for life adventure,

Anything wey I be today, na my teacher point me for the right direction,

I dey pay attention and they no get shut me down if I ask question,

Dem straighten all my rough edges to perfection,

 

4) Teaching na one umbrella wey cover other professions,

Every doctor, nurse or lawyer get academic intervention,

Anybody wey sabi read book suppose comot gele for im teacher,

Their reward suppose start from earth and no dey so meager,

Teachers na candles wey dey burn make others fit see road like good leaders.

 

 

This poem by Chidera Amarachi Udochukwu emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.

 

Chidera Amarachi Udochukwu

Chi Deraa is an award winning poet laureate and writer, she is a two time winner in the 2022 Shuzia Poetry and Prose Contests amongst others. She is also the 2022 winner of Movement of the People poetry contest organized by Seun Anikulapo Kuti. She is a contributor to Shuzia, the Marked Anthology, Our Stories Defined Anthology, D’lit Review, Aayo, Tush Magazine amongst others.

Subscribe
Notify of
guest

3 Comments
Newest
Oldest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments